Former Nigerian President Muhammadu Buhari don die at di age of 82.
Former presidential spokesman Garba Shehu say ex-president Muhammadu Buhari die for one hospital for London.
Buhari serve as military general in di 80’s and elected president twice afta di kontri return to civilian rule in 1999.
Dem bin overthrow im goment in 1985 by di den General Ibrahim Babangida.
E die two years afta e comot from office in 2023. E bin serve as president from 2015-2023.
Dem go bury di former president under di islamic rites, politicians and oda key political actors go pay dia respect to di deceased family.
